LEAD

Mertesacker don hang hin boot

Mertesacker don hang hin boot Per Mertesacker wey be Germany centre haf wey also be member of de squad wey win de World Cup for Brazil lass month don komot hand for international football to settle for club football. De 29-year-old Arsenal playa be de third squad member wey don retire since de end of de World Cup, afta skippo Philipp Lahm and ogbonge goalscorer Miroslav Klose don retire. "I dey proud as I spend 10 years for de team , five big tournaments, 104 caps and de World Cup wey we kon win", naso Mertesacker yarn for statement. "Na wonderful and betta end e bee, na de right time e bee for me to waka from de national team and allow younger playas to enta de team. Mertesacker, wey juss enta lass minite for de extra time for Germany's 1-kondo final win over Argentina also yarn de Sueddeutsche newspaper say hin wan check wen hin international football work go finish. "Fess of all, na my matta we dey tok about so, to be able to tok wen de chapter don end", naso hin tok. Tall and powerful, de defender be Germany fess choice centre back lass time tay-tay afta hin fess cap win for 2004. Mertesacker kon loss hin place wen coachi Joachim Loew kon post Jerome Boateng and Mats Hummels for de middle of de back four wen dey bulala Brazil 7-1 for de semi-finals of de World Cup. Loew bin also start with de same two combination for de final. "Dat tournament be golden finale", naso Mertesacker yarn. "Now I wan be Premier League champions with Arsenal and also attack de Champions League". Mertesacker don tap ball for three World Cups and also follo for de 2008 and 2012 European Championships. "Hin dey dependable and reliable, naso Loew tok, "For Brazil hin be one of our mos important playas wey helep de team and show dem way for plenty swaggar". Arsenal dey launch dia Premier League season with London derby against Crystal Palace for Saturday.
Previous
Next Post »

Whats Your Experience Like On Our Blog