LEAD

Flying Eagus win as Lesotho no gree show

Flying Eagus win as Lesotho no gree show De Naija Under-20 football team wey be de Flying Eagus don kwalify for de 2015 Africa Youth Championship (AYF). De Flying Eagus kon kwalify for de AYC for Saturday afta dem don walk over dia opponents Lesotho for de final round of kwalifying for Kaduna. Match officials kon dey tok even till de lass minite say dem never receive any official notice say de fess leg for de final kwalifayas no go hold afta Lesotho don begin dey fear becos of Ebola virus wahala for Nigeria. Na dis make dem to kon do de walkover ceremony wey lass for 15 minite afta de referee don blow de kick-off whistle. Nigeria go now join seven oda countries wey include de hosts Senegal for de 2015 AYC, wey go begin from March 8. Manu Garba wey be coachi for de Flying Eagus no waste time sam sam to hail hin playas afta dey don confirm dia kwalification without tapping ball. “Congratulations Naija for dis kwalification, we bin train very hard for de lass two months for dis match and belle for sweet us pass if say de kwalification shele for pitch and not for boardroom”, naso hint ok. De Naija coachi kon take dat chance pity Lesotho as dem no show face for de game. ”Na one kain disappointment e bee say Lesotho no show face for de game, but we no fit do any thing about de matta”. Garba tok say de team go now komot from dia camping and kon arrange demsef fass fass for de main tournament.
Previous
Next Post »

Whats Your Experience Like On Our Blog